in

Nnamdi Kanu Denies Responsibility For What Happened In Lagos During EndSARS Protest – DSS Video

Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) don deny responsibility for di destruction of property wey happen for Lagos state during di EndSARS protest of October 2021....CONTINUE READING THE ARTICLE FROM THE SOURCE>>>

Dis na one of di tins wey come to light for di ongoing trial of di secessionist leader wey Nigerian goment dey accuse of terrorism.

For di hearing on Thursday 8 May, Adegboyega Awomolo wey be di lawyer to di Nigeria goment call out di second witness – Mr BBB – to continue wit im witness, and di court also play one CD plate wia DSS officers dey interview Nnamdi Kanu for dia headquarters for Abuja for July 17, 2021.

For dat video, Kanu wearing black sweater dey wit im lawyers – one of dem na Aloy Ejimako.

Di DSS officers ask Kanu weda e dey aware say im broadcast on October 20, 2020 bin lead to violence, killings and destruction of public infrastructure for Lagos State, Kanu say “Lagos no be Biafran territory so wetin happun for Lagos no fit dey attributed to me”.

“But you get authority ova all di pipo for di southeast?” di DSS officers bin ask Kanu, and e say e no get such authority.

“If I get dat kain authority ova dem, I no for dey call for referendum, I for just wake up one day and say make we get Biafra,” Kanu tok.

“We get republican orientation. Anybody wey claim say e get control ova di pipo of di east dey make mistake. We dey republican in nature,” Kanu tok.

E say even though im be leader of di Ipob movement, di running of di day to day affairs of di group na di job of di directorate of state of di group.

Wen dem ask am weda e dey aware say Ipob elements don dey associated wit violence and killings, Kanu reject di allegation kpatakpata.

“You just dey look for somtin wey you go pin on Ipob to call am violent group.”

Di DSS pipo ask Kanu about di statement im bin make on 30 May 2021 wia e call for sit-at-home, e respond say e call for sit-at-home true-true, but e no force anybodi.

“E just be like wen your pikin offend you for house and you say to am ‘I go kill you today’, shey dat one mean say you go kill di pikin?” Kanu tok for di video.

For im final remarks for di video, Kanu tok say: “Di pesin wey ask di army to attack my house, dat pesin na di real enemy, becos I bin already dey for discussions wit eminent pipo for di southeast including Professor Ban Nwabueze as we dey try to get political solution to dis matter.”

Afta di video finish playing, Mr BBB tell di court say from dia investigations, dem establish say many of di killings wey bin happun for di southeast dey directly connected to di broadcasts of Nnamdi Kanu.

Some of dem include di killing of former special adviser to di President, Ahmed Gulak, wey dem bin kpai on May 30 wey be di day Kanu bin declare as sit-at-home.

Anoda one na di murder of one army couple – Gloria Mathew and Linus Musa – wey dem kill and cut off dia heads as dem dey travel for dia traditional marriage, and also di killing of one retired justice.

Afta Mr BBB conclude im testimony, di trial judge James Omotosho adjourn di matter to May 14, 21 and 22 for continuation of hearing…CONTINUE READING>>

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Police Arrest Alfa For Beating Sick Wife Over ₦800 In Ibadan

Michelle Obama Says Husband, Barack Joked That She Was ‘Next Up’ After Her Mom’s Death